Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Defence Minister, Mohammad Badaru Abubakar, don yarn say no officer or soldier wey dey do lawful duty go suffer punishment following wahala wey happen between soldiers and FCT Minister, Barr Nyesom Wike, for Abuja on Tuesday. Badaru yarn dis one during ministerial briefing to flag off 2026 Armed Forces Remembrance Day celebration for National Defence College. E talk say, “We go always protect officers and our armed forces personnel wey dey do lawful duty. Any officer wey dey do im work lawfully go dey protected if e dey do am well.” Dis come after retired military veterans yarn say dem go mobilise and occupy FCT ministry if any officer wey dey act on lawful order suffer anyhow.
On national security, Badaru yan say under President Bola Tinubu, Ministry of Defence don achieve plenty milestones to protect Nigeria, neutralise over 13,000 terrorists and criminals, arrest 17,000, rescue almost 10,000 hostages, plus over 100,000 Boko Haram and ISWAP fighters and dia families don surrender. E add say ministry don destroy over 1,900 illegal refining sites for South-South, improve defence tech like AFVs, UAVs, naval vessels and strengthen whole-of-society approach. Meanwhile, Wike aide, Lere Olayinka, yarn say former Chief of Naval Staff, Vice Admiral Awwal Zubairu Gambo, get land wey dem scam am on for Abuja wey suppose be park, no be residential. E talk say instead make Gambo dey angry with FCTA officials wey dey do lawful duty, make e face the people wey sell am di land scam.
Written by: News Editor 1
Nigeria Defence Minister news Nigerian soldiers Wike statement news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025