Lagos

NSCDC Burst Baby Factory for Badagry, Rescue 18 Pregnant Women, 10 Pikin 

todayApril 17, 2026 3

Background
share close

NSCDC Lagos Command spokesman, Afolabi Babawale, tuk say dem do small jet li  burst one baby factory for Okuju, Ilado for Badagry on Wednesday night into Thursday morning after dem get tip-off about the illegal operation.

Babawale explain say operatives raid di place, rescue 18 pregnant women and 10 pikin, and arrest the operators, Joy Okeke and Raphael Agwu.

According to am, the victims wey dey  between 18 and 30 years join the centre through Facebook offer, where dem promise dem money say  if dem born pikin  and sell.

E add say after delivery, dem dey sell the babies to buyers while paying the mothers between N500,000 and N1.8 million, and the rescued victims don dey for dia office for Ibereko, Badagry.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app