Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Police Command talk yesterday say dem go carry 55-year-old NURTW official, Samsideen Oladiti wey people sabi as Shamelon, go court over im hand inside two violent wahala wey happen for Lagos Island. According to wetin police talk, di offences wey dem hold am for na murder and another one wey involve serious beating wey cause injury. Right now, Oladiti dey inside State CID for Panti-Yaba as dem dey do coded investigation. On September 17, 2025, around 3:00 afternoon, dem say di suspect attack one dispatch rider for Lagos Island. E use helmet and im bare hand take beat di guy scatter, injure am well well. Dem rush di victim go hospital, put am for oxygen, and till now e still dey receive treatment.
Di next day, around 11:00 morning, police talk say another person come report Oladiti again over one gbege wey happen on August 28, 2025. For di wahala, dem say di suspect use metal ring take knack one man for head and face plenty times, wey give di guy serious injury. Even with all di treatment, doctor later confirm say di man don die on September 17. Dem don carry di body go mortuary for autopsy. Lagos State Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, wey follow im officers go check di scene of di incident, don assure residents say di suspect dey inside cell and go face justice once investigation finish. Police spokesperson, Abimbola Adebisi, still confirm say dem go carry di suspect go court once dem finish di investigation.
Written by: News Editor 1
COURT CASE LAGOS STATE POLICE COMMAND NURTW
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025