Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Ogun State Police Command don block one robbery attempt for Sagamu after quick and sharp response from operatives of Sakura Division. Di Police PRO, CSP Omolola Odutola, yarn say di incident happen for early hours of Tuesday after dem receive distress call from di CDC Chairman of Okearedi, Araromi, near Sagamu–Ijebu Ode Expressway, say about five hoodlums dey try force enter one house. As police team reach di area, di suspects run scatter, but di officers pursue dem and recover di black Lexus GS 350 wey dem wan use escape. Inside di motor, dem find fireworks (knockouts) wey di thieves dey plan use as distraction. Di Commissioner of Police, CP Lanre Ogunlowo, hail di officers for quick action and assure say di command don beef up security, deploy men to key areas, and dey ready to respond fast to any wahala.
For another gist, Ogun Police Command don again show say dem no dey sleep as dem rescue one kidnap victim wey armed men carry for Onipanu area of di state. Di incident happen on October 27, 2025, around 8:14pm when five gunmen off generator for one compound to lure di occupants out. Di victim, Baki Atoyebi, come out to check but dem grab am and collect N900,000 cash, PoS machine, three phones, power bank, and car keys. CSP Omolola Odutola confirm say di kidnappers later call di family use di victim phone demand N30 million ransom, but police don step in to track dem down and secure di area.
Written by: News Editor 2
Ogun police news Sagamu robbery
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025