south west

Ogun Police, NDLEA Join Body to War Against Drug Abuse

todayApril 17, 2026 6 1

Background
share close

Ogun Police Command don call for beta join-body work wit NDLEA to tackle drug abuse and trafficking for di state.

Police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi,  naim dey konfamate dis mata, say Commissioner of Police, CP Bode Ojajuni, don even visit NDLEA office for Abeokuta for di collabo mata sef.

Say dem agree to dey share intelligence, do joint operations, and also carry public awareness go communities.

NDLEA also honour CP Ojajuni wit War Against Drug Abuse (WADA) ambassador title for di  support wey im show, say im try.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app