Sports

Oliseh: NFF Chop $1M World Cup Money, No Pay Players

todayOctober 14, 2025 3

Background
share close

Former Super Eagles skipper and coach, Sunday Oliseh, don open nyash for Nigeria Football Federation (NFF) say dem pocket $1 million wey FIFA send make dem share with players wey hustle qualify Nigeria for di 2002 World Cup, na wetin For one podcast wey dem call Home Turf, Oliseh yarn say him and di federation get agreement to share di money 50-50, $500,000 for NFF and $500,000 for di 30 players wey play di qualifiers. “We agree say, ‘Okay, make we split am 50-50.’ Each player suppose collect about $18,000,” Oliseh talk. “But di only way wey dat money go reach everybody na if me, as captain, dey to monitor am.”

Oliseh come drop bomb say na why NFF sharply scatter di team after dem don qualify, comot all di senior men like him and Finidi George from di final World Cup squad. “To make sure say di money no go reach us, dem remove me and Finidi,” him talk. “80% of di players wey go 2002 World Cup no even play qualifiers, so dem no suppose touch dat money and NFF no give di rightful players anything.” Di matter don raise fresh gbege on top how NFF dey run things, as dem never talk anything about di allegation till now.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app