By Ebi Oboko
Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, dey vex serious, say jaguda boys dey worry pipo, so like dis im don send security make dem double for all communities and forest areas, after New Year attack for Ipele police station for Owo LGA.
The attack happen Wednesday night as plenty people dey attend night service to welcome 2026.
Di Govo say, di mata nor dey let am sleep, so im don put call to police and army brigade commander make dem send dia men to protect ondo people.
Im also meet heads of security agencies for Akure to review wetin happen and how to make sure, dat kin anyhow doings nor repeat e self for Ondo state.