OBODO NAIJA

Ondo Monarchs Beg Tinubu to Share Pipeline Surveillance Power for Ilaje 

todayApril 17, 2026 2

Background
share close

Monarchs from Ilaje Local Government Area for Ondo State don wire  appeal  letter wi oga  Presido,  Bola Tinubu make dem dis pipeline surveillance work touch everywia.

Di traditional rulers under Ilaje Council of Obas tuk dis one inside letter wey dem send to President and sign by Secretary, Oba Obafemi Ogbaro, after dem meet for Igbokoda headquarters on Friday.

Dem explain say di current central system dey limit community involvement and e dey create security gap wey fit affect oil assets and peace for coastal areas.

Dem beg federal gornment make dem involve local communities more so  dat, dem fit help reduce vandalism and protect national resources better.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app