National

Ondo Police, FAAN Disagree Over Who Dem Arrest For Akure Airport

todayMarch 17, 2026 3

Background
share close

Ondo State Police Command don disagree with Federal Airport Authority of Nigeria (FAAN) over di pipo wey dem arrest for Akure Airport on Sunday.

Di Police tuk say di people wey dem arrest no be bandits, na ordinary criminals, and dem want make FAAN no misrepresent di case.

Managing Director of FAAN, Olubunmi Kuku,  bin konfamate dat dem gbab four suspected bandits for Ondo airport.

Say dem don alert di CP, di army, di MAC, and AVSEC pipo, dey all work together to handle di mata, an now say na just ordinary jaguda boys and nothing like bandit for di mata.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app