By: Esther Ayoola
Say at least 22 passengers wunjor afta train wey from Abuja dey go Kaduna head shake for im corridor, forcing di train to stop and delay di journey.
According to report About 429 passengers and 70 crew members bin dey inside di train when di incident hapun.
Managing Director of Nigerian Railway Corporation, Kayode Opeifa, konfamate di number of pipo wey wunjor when im visit di corridor
Opeifa tell journalists for Kaduna say di rail line still dey safe for commuters despite di incident.