Lagos

One Person Kpai As Jaguda Boiz Scatter Ground For Lagos

todayDecember 4, 2025 4

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

At least one person don kpai afta heavy fight burst between suspected Aiye and Eiye cult members for Awoyaya, Ibeju-Lekki, Lagos.

Di fight burst from Monday enter Tuesday, and before people know wetin dey sup, one guy wey dem sabi as Pelebe don kpai inside di cult gbege.

Videos just dey show show bodi online how di wahala, take scatter pipo for Awoyaya .

Di video show am lying for ground, body no stable, as di whole area scatter.

As at di time wey we take package di report, police still neva talk anything on di matter.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app