By: Rilwan Agbomeji
Galatasaray and Super eagles Striker, Victor Osimhen don yarn say e dey try make im Super Eagles padi, Ademola Lookman and Raphael Onyedika, join am for Galatasaray.
Di Naija striker talk dis afta Galatasaray draw 1-1 with Atletico Madrid for UEFA Champions League match wey happen on Tuesday night for Rams Park.
Osimhen yarn say e dey work actively to bring Onyedika and Lookman enter im team, say if dem join one of di biggest clubs for di world, e get plenty advantage.