OBODO NAIJA

Osun Gornment Pay Fresh Palliative Give Civil Servants

todayAugust 5, 2026

Background
share close

By: Esther Daniel

Osun State Gornment don pay anoda round of palliative give civil servants across di state to help reduce di effect of di hard economy.

Gofnor Ademola Adeleke spokesperson, Olawale Rasheed, tok for Wednesday say di payment show say di gornment remain committed to workers’ welfare.

Im add say di administration start regular palliative payments before implementing di new minimum wage for Osun State.

Di gornment say di programme go continue to improve workers’ morale, strengthen public service, and deliver better service to Osun people.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds