By: Esther Ayoola
Police for Osun State don arrest one travel agent wey dem dey accuse say im scam two pipo of N3.6 million.
Say di money na for visa and flight tickets to Luxembourg.
Tuk, tuk of di osun police command, DSP Abiodun Ojelabi, explain, say di victims meet di suspect through one friend for January 2025.
Dem give am di money make e arrange di visas, but instead, Oga visa man, use di money guide and now e dey police net.