By: Esther Ayoola
On Tuesday say nor be small tin sup for For northwest Pakistan, dat a suicide bomber pack im explosive tools for Marua (keke) kpai, kpai at least 7 pipo and wunjure about 20 others for one checkpoint attack.
According to Police, di man na very anyhow man, e first near two traffic officers for di checkpoint before e release di bomb.
Senior police officer, Muhammad Sajjad Khan knonfam to new pipo, dat dis attack sef dey come just days afta another suicide bombing for Bannu, kpaing at least 15 pipo.
Authorities blame di violence on terrorists wey dem say dey operate from Afghanistan, as Pakistan foreign ministry don already summon Afghan top diplomat on Monday over di mata.