By: Esther Ayoola
Peru Congress don fire interim presido, Jose Jeri, wey be di seventh presido of di kontri and e don ruleĀ for di last ten years.
Dem accuse am say e hire plenty women for him gornment and say e dey linked to one Chinese businessman for corruption wahala.
Jeri take over from leader Dina Boluarte, wey dem bin impeach, because pipo complain about di wahala for di country.
Prosecutor don already start check whether Jeri use him power too much to put pipo for gornment or not.