National

Police Arrest Suspect Afta Two Nollywood Actors Kpai For Set

todayFebruary 17, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

World pipo say, problem nor dey finish, Dat like dis, police don arrest food delivery guy over di death of Two Nollywood crew members, Ekemini “GeeTee” Imeh and Ayodeji Walter Odediran.

Say dem kpai for location wey dem bin dey shoot film for Lekki area Lagos.

Lagos State Police tuk, tuk, CSP Abimbola Adebisi, ni dey konfamate dis report, say police don arrest di suspect.

According to di police, di two crew pipo enter one parked Nissan to rest afta dem don set up lighting for di film wey Boma bin dey direct.

Investigation sti dey go on to find out how and why dem take kpai, so as mata unfold, we go update.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app