OBODO NAIJA

Police Assure INEC Say Dem Go Provide Maximum Security For Lagos

todayMay 14, 2026 1

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Lagos State Police Command don assure say dem go join body with Independent National Electoral Commission (INEC)  ahead of  di 2027 general election, to make sure say gbege no burst for Lagos at all at all.

For statement wey police tuk tuk pesin, SP Abimbola Adebisi drop on Wednesday, after INEC officials pay courtesy visit for police headquarters for Ikeja.

Lagos State Resident Electoral Commissioner, Abayomi Salami wey lead di visit, hail CP Tijani Fatai for im new appointment, come press say make Lagos State Police Command no relent, as preparation for di 2027 general election don start.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds