Local

Police Burst Thief Hideout For Ado Ekiti, Arrest Four Suspects

todayJuly 6, 2026 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Ekiti State Police Command do small kpichao arrest four suspect, say dem bin wan go move tins from shops inside  Omisanjana area of Ado Ekiti.

Police tok say dem raid one criminal hideout on Sunday and gbab one, Abdurazak Suleiman, John Okori, Francis Okori and Kehinde Alabi.

As police look di holes dem, dem see plenty items, property wey di guys dem thief, including perfumes, bathing soaps, drinks, foodstuff, clothes, school bag and one 3kg gas cylinder, I be like say na hungry thief dem be.

Police still recover one sledgehammer wey di gang dey use take break into shops, while investigation still dey continue.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds