Lagos

Police Don Open File As Dem Find Two Dead Bodies Dumped For Inside Lagos Canal

todaySeptember 12, 2025 6

Background
share close

Lagos State Police Command don launch investigation after dem find two young men dead, dumped for canal for Igando area. Around 8:30 a.m. on September 9, 2025, two male bodies wey nobody sabi were discovered tied together with rope inside one canal beside Arowolo Filling Station, along LASU/Iba Road, Igando. The victims, wey dem believe dey between their 20s and 30s, get nylon cover their faces, and dem hands and legs tie for back before dem throw dem inside the swamp.

The Lagos State Police Command, the acting PRO, Babaseyi Oluseyi, talk say, “Police don start investigation to know who the dead men be and wetin really cause their sudden and suspicious death.” “The bodies don carry go Mainland General Hospital Mortuary for autopsy. Lagos State Police Command dey work to find out who the dead men be and wetin really happen to dem,” dem talk.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app