Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Two pikin don reportedly die for Oworonshoki, Lagos, as police deploy full ground to control wahala wey burst from di new demolition wey Lagos State Government start again. Police full everywhere from Iyana Oworo reach Adeniji Adele after some residents threaten say dem go block road for protest. Fresh demolition start around midnight for Coker and Ojulari area, just one day after government yarn say about 80 landlords don collect compensation. Lagos State Urban Renewal Agency talk say dem still dey plan another round of compensation. Residents talk say di tear gas wey police use to scatter crowd cause injury and kill small baby and one five-year-old girl. One man, Idris Adeleke, talk say him and him family don turn homeless as government demolish dia house for night without allow dem carry anything. Another resident, Ismaila Anifowose, cry say he don lose three houses in different areas despite paying rent and borrow money to settle.
Meanwhile, one Civil Society Organisation, Spaces for Change (S4C), don blast di Lagos State Government over di demolition wey happen for Oworonshoki, say di matter still dey court. Di group’s Executive Director, Victoria Ibezim-Ohaeri, talk say court don give order since October 23 stop di government and LASBCA from breaking houses for Ajileru, Ososa Extension and Toluwalase Extension, but dem still carry bulldozer enter with police support. She talk say this act show total disrespect to di court and di right to property wey Section 43 of di Constitution guarantee. S4C come beg government make dem stop di demolition, compensate or resettle di affected residents and punish any police officer wey attack peaceful protesters.
Written by: News Editor 2
Lagos demolition news Lagos police deployment
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025