Sports

Police Grab Suspect Wey Tif Super Falcons Players Money For Morocco Hotel

todayJuly 27, 2026 5

Background
share close

By: Esther Daniel

Police don arrest one suspect wey confess say e tif cash from some Super Falcons players for Marriott Hotel, Casablanca, Morocco, few days before Nigeria first match for 2026 Women’s Africa Cup of Nations.

Di suspect go return all di money wey e thief, while criminal case don ready to start against am.

Midfielder Esther Okoronkwo tok say, goalkeeper Chiamaka Nnadozie, defender Michelle Alozie and captain Rasheedat Ajibade na among di players wey lose more than $1,000 from dia hotel rooms.

Di incident happen for di last day of Nigeria training camp for Casablanca before di team move go Rabat for dia Group C matches, as Okoronkwo also accuse hotel staff say dem no handle di matter well after di players report di theft.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds