Lagos

Police Kramp Anthony Joshua Driver For Driving Wawa

todayJanuary 2, 2026 5

Background
share close

By Ebi Oboko

Ogun State Police don confamate say dem don arrest the driver of the Lexus SUV wey get accident wey kill di two frens of former boxing champion Anthony Joshua.

The accident happen on Monday for Lagos-Ibadan Expressway as the vehicle jam stationary truck, kill Latif Ayodele and Sina Ghami on the spot, while Joshua and the driver get minor injuries.

Police PRO Oluseyi Babaseyi talk say investigation dey go on to know wetin cause the crash and the role of the driver.

Ogun State Governor, Dapo Abiodun, also confirm say Anthony Joshua don discharge from hospital and dey recover well for house.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app