By: Alice Iduh
Portable don fire shot for social media as e call out Tanzanian singer Juma Jux for enter Naija coded and drop song with Ekunrawo without even hail am.
Na for him Instagram page, the controversial street singer para troway, demand say dem must create space for am on the new track “Halima.”
Portable talk say Juma Jux sneak enter the country and e no dey okay say dem run collabo behind am.
As the tori land online, fans begin spark hot reactions, some dey ask why Portable dey vex like this, while others yarn say Juma Jux better ignore am.