By: Rilwan Agbomeji
To deal with all di jaguda bois for inside di obodo Naija, wi oga Presido Bola Tinubu don vex oh, approve forest bodi guards across Naija say dem dey carry kalachi as part of new plan to fight banditry, kidnapping and illegal mining for rural areas.
Di announcement come afta Federal Executive Council meeting for Abuja on Wednesday, where Tinubu talk say security matter don reach level wey require better-equipped local forces.
According to di presido, forest guards go now act as ring leaders for di fight against insecurity to protect forests and communities