By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Tinubu like dis, dey cut cap for senior govo, di b4, b4 govo Osun StateĀ and APC pioneer chairmo, Chief Bisi Akande, as e clock 87 years of age.
Tinubu describe am as mentor, ally and strong pillar wey hellep build and sustain democracy for Naija.
According to Oga Presido, Baba Akande follow Obafemi Awolowo political ideology and later leave im accountant work forĀ public service fully.
Tinubu tuk say, Akande serve Naija wella and diafore deserve all di celebration for today wey be birthday.