By: Esther Ayoola
Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu, don sukilli mouth untop marras dat, Afrobeat oga, Fela Anikulapo Kuti na senior man ni be, and dat im music pass music, afta e win Grammy Lifetime Achievement Award even afta death.
Inside statement wey im personally signed, Oga Jagaban describe Fela as fearless, freedom fighter, and revolutionary wey dey fight injustice through im music.
Presido say Fela courage, creativity, and conviction define one generation and dey still inspire di world today.
Baba Seyi end by saying day in fact, Yoruba belief say, though fela don kpai but him legacy go last forever, and na so e be across di obodo Nigeria.