National

President Tinubu Make Move To Repackage Police Trust Fund Law

todayApril 22, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don ask National Assembly make dem repeal and re-enact di Nigerian Police Trust Fund Act 2025, as part of move to strengthen police system for di obodo Naija.

Speaker of di House of Representatives, Tajudeen Abbas, naim read di Baba Seyi letter for di House chamber for Abuja.

According to Tinubu, di reform go hellep improve how dem dey manage di fund, boost training for police officers and make dem more professional for duty.

E add say di plan go also provide beta equipment and improve welfare of Naija Police Force to enhance security across di country.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app