By: Esther Ayoola
Wi oga presido, Bola Tinubu don repeat talk again, say make police officers nor guard VIPs again and make dem return back to normal police work.
E talk dis one just before e begin federal executive council meeting for state house, Abuja on Wednesday.
From aproko wey reach konfam news table say, Tinubu don direct minister of interior make e work with IGP and NSCDC make dem quickly replace any withdrawn security so dat people no go dey exposed.