By: Rilwan Agbomeji
US Presido, Donald Trump don comot im threat to put tax for European countries wey no like im plan to take over Greenland.
E tuk dis one yesterday for Davos wia im hold meeting with leaders for Europe, say e no go use force take di land again, and im dey try do deal wit NATO Secretary-General Mark Rutte.
Trump talk say if dem fit agree, e sure say everywia go good for US and all NATO countries.
Dem sef dey discuss Trump “Golden Dome” missile defence plan and di Greenland mata.