By: Esther Ayoola
Oooh, US presido, Donald Trump dey find trouble sha, say im don invite Russian Presido Vladimir Putin make e join im “board of peace” wey go try solve all di shootie shootie wey dey go on for di world and hellep manage Gaza war.
Dis invitation sef dey come, when Russia sti dey war with Ukraine, di mata sef don tey, nearly four years.
Trump dey try stop di war, but wahala dem say nor dey finish as peace tuk sef jam rock.
Kremlin say, dem wan clear all di details with Washington, but dem no fit tuk if Putin go join di peace waka.