By: Esther Ayoola
Australia Prime Minister Anthony Albanese don clear mata say im govament no go support any jaguda doings and dat Australian go send woman an pikin wey get tie with ISIS fighters.
Untop tuk tuk with tori pipo on Monday, Oga prime minister say e dey “unfortunate” say pikin dem dey involved, but Australia no go look back on dia decision.
Albanese say any person wey use im two eyes join ISIS, terrorist group, make dem face di wahala wey go come with am.
Also untop yanings for social media Australia Home Affairs Minister spokesperson repeat di same tuk say, any person wey return from Syria after the ISIS mata, go sti face di law for Australia.