Sports

Promoter Eddie Earn Konfamate Dat Anthony Joshua Moral Low

todayFebruary 13, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Anthony Joshua promoter, Eddie Hearn, don drop bumbshell, say e no sure whether Joshua go fight again after im lose two close padi for car crash for Naija.

Joshua don dey try enter gym small, but e never sti do any proper training for boxing.

U sabi say, afta e knock Jake Paul finish, Joshua travel come visit family, but wahala sup, when im car get askident,  kill  two of im closest  padi mehn, Sina Ghami and Latif ‘Latz’ Ayodele.

And based on dis, Joshua March fight and possible fight with Tyson Fury dey uncertain now.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app