Sports

Raphinha Fire Two As Barca Scatter Feyenoord 5-1 for Champions League

todaySeptember 10, 2026 3

Background
share close

By: Ayobami Dada

For Wednesday UEFA Champions League match, Barcelona Captain, Raphinha continue im fine goal-scoring form as e score two goals to hellep Barca scatter Feyenoord 5-1 and start dia Champions League campaign with big win.

Karim Adeyemi score one beautiful long-range goal, while Lamine Yamal bend one free-kick enter net as Hansi Flick boys dominate dia Dutch visitors.

After Sem Steijn score one goal for Feyenoord, Barcelona substitute Gabriel Jesus add di fifth goal, wey be im first goal since e join di Spanish club from Arsenal dis summer.

Barcelona, wey last win di Champions League for 2015, don win all five matches across all competitions dis season, and dem don score five goals in four of dia games.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds