National

Rauf Aregbesola Reject Move Say Im Nor Dey Return To Im Former Ex, APC

todayMay 11, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Former Osun state Govo, Rauf Aregbesola don clear di air, say e sti dey with African Democratic Congress and no plan to go back to im ex, All Progressives Congress.

Im yarn dis one for meeting inside Ilesa on Sunday, Aregbesola tell party members from all 332 wards say rumour about im return to APC na pure lie.

Di former Osun State govo sti use di meeting present Dr Najeem Salaam as ADC governorship candidate for di August 15 election.

Aregbesola press yarns, say, since im comot from APC over three years ago, e never see any reason to look back again.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds