OBODO NAIJA

Reps Approve Customs N11.07trn Revenue Target for 2026

todayJuly 6, 2026 6

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Di House of Representatives Committee on Customs don carry hand up approve di2026 budget for Nigeria Customs Service, with target to make 11.07 trillion naira revenue.

Customs Boss, Adewale Adeniyi, tell di lawmakers say di target make brain because dem beat dia 2025 target when dem clear 7.25 trillion naira.

For di new budget, Customs allocate big money for capital projects, staff overhead, and dem even plan to employ almost 4,000 new officers to join di work.

Di Committee Chairman, Leke Abejide, talk say dem don study everything and di final report go land for di House floor on Wednesday for final signature.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds