OBODO NAIJA

Rescued Oyo Pupil Tuk Say Him No Dey Fear To Resume School

todayJuly 16, 2026 4

Background
share close

One 15-year-old student, Bello Hassan, wey kidnappers carry from school for Oriire Local Government Area of Oyo State, don finally tell im story after spending 56 days for kidnapper hand.

Despite everything wey happen, Hassan talk say, he no dey fear to go back to school.

Hassan yarn dis one for journalists on Wednesday for Ogbomoso, shortly after doctor’s discharge am from LAUTECH Teaching Hospital.

E talk say after dem gbab am with other students and teachers, dem force dem to trek from morning till night before dem reach di kidnappers’ camp around 7 p.m, say na under trees dem dey sleep before security operatives rescue dem.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds