By: Esther Ayoola
National Association of Resident Doctors (NARD) on Tuesday announce say dem don suspend dia planned strike afta dem meet with Federal Government of Naija for Abuja.
NARD say, gornment don promise to pay outstanding salaries, hazard allowance, and improve doctors welfare, wey be di main reason why dem decide give dialogue another chance.
Di suspension come afta emergency meeting of NARD National Executive Council, where dem review gornment assurances and see progress for negotiation.
More go come our other bulletins