Sports

Rivers United Eye Second NPFL Title ,Package Bendel Insurance 3-1

todayMarch 9, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Rivers United don continue dia moral fight to win dia second Naija Premier League title beating Bendel Insurance 3-1 for Adokiye Amiesimaka Stadium for Port Harcourt on Sunday.

No goal for first half sha, but Chijioke na im head in a coner kick, putting  Rivers ahead  for 53rd minute.

Douglas sti deliver assist for 81st minute, set up Wisdom Samuel making it two.

Bendel Insurance score one back for 89th minute, but Samson Obi get oda plans, seal di game 3-1 for Rivers United.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app