By: Yusuf Abuh
Mohamed Salah don move into di same house former Super Eagles striker Anthony Nwakaeme dey stay before for Trabzon, Turkey, after Salah join Trabzonspor.
Trabzonspor Presido Ertugrul Dogan confirm di matter and say di club provide houses for players as part of dia arrangement.
Dogan explain say Salah current house na di same property Nwakaeme use when e play for di Turkish club.
Di club presido say nothing strange dey about di arrangement, as Trabzonspor get several houses wey dem provide for players.