Entertainment

Sam Larry Land for Hospital, But Him Bouncer Kpai

todayJuly 6, 2026 15

Background
share close

Popular Nigerian music promoter and socialite, Sam Larry, don land for hospital after one serious motor askident wey happen for Lagos-Calabar Coastal Road.

According to reports, di askident happen on early Saturday morning as di motor wey carry Sam Larry jam one trailer and di motor scatter well well.

Reports also talk say Sam Larry  bouncer no survive di askident, as e kpai for di scene before help fit reach him side.

Videos and pictures wey dey waka for social media show di motor don mash up for front, showing how serious di crash be.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 8


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds