By: Esther Ayoola
Saudi Arabia Foreign Minister Prince Faisal bin Farhan Al Saud don warn Iran on Thursday, for Riyadh say dem no go dey tolerate any more attacks for Saudi Arabia and neighbouring Gulf states.
Im yan dis give tori pipo for di Saudi capital, dat Iran don dey attack dem since dem keep quiet nor mean say Saudi Arabia nor get power, dat dem get strong military power, if dem choose to respond.
Prince Faisal explain say dem no go tuk wetin fit trigger dia defensive action, because dem no wan give Iran clue on how Saudi fit defend dia country.