By Ebi Oboko
Wi oga Senate Presido, Senator Godswill Akpabio, in the spirit of the new year don tell him lawyers make dem withdraw all di defamation cases wey e get against some people for inside the obodo naija.
Akpabio speak on Thursday for Sacred Heart Parish, Uyo, say e get almost nine cases for court against people wey e accuse of defaming am.
E explain say e hear di priest for New Year Mass and e suddenly realise say e gats forgive dem, so e decide to withdraw di lawsuits.
Last year, Akpabio still file one big defamation case against him colleague, Senator Natasha Akpoti Uduaghan, so dat case like dis, based on the words of the oga senate presido, go end this 2026.