By: Esther Ayoola
Say like dis, Senegal dey plan show dia Africa Cup of Nations trophy before dia game wey dem go play against Peru for Paris on Saturday.
Dis na according to head of Senegal Football Federation, Papa Amadou Diop.
Nor be amebo say, Di Teranga lions win dia second Afcon trophy on 18 January afta dem beat Morocco 1-0 for Morocco, but di win, issue full am based on say Senegal players waka comot when Morocco get stoppage-time penalty.
Last week, Confederation of African Football (CAF) give Morocco 3-0 win.
Now, Court of Arbitration for Sport (CAS) don konfam say dem don receive Senegal appeal and dem go decide as fast as possible to fix di mata.