obodo oyinbo

Seoul Accuse Kim Jong Un Say E Wan Make Im Girl Pikin Next Leader For North Korea

todayFebruary 13, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

North Korea leader Kim Jong Un, like dis dey face beta gbasgbose say im dey plan to make im  13 year old girl pikin, Kim Ju Ae,  di  next leader of  North Korea

According to  Seaul spy agency,  say di pikin just dey  follow her papa up an down, attend big big events, like im first trip to Beijing for September.

South Korea National Intelligence Service  say, like dis dem don dey touch light di mata, even before di mata reach public.

Dem sti say, dem go dey watch if she go enter North Korea big party wey dem go do dis month, in case of any kpakam, say dem go show beta workings.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app