Entertainment

Shakira Link Up Burna Boy, Tease New World Cup Gbedu “Dai Dai”

todayMay 8, 2026 2

Background
share close

By: Jolayemi Olajide

Colombia music queen, Shakira don drop  2026 World Cup gbedu, dem title “Dai Dai”, shoot small video for Brazil Maracana Stadium yesterday.

Di Colombian singer wey sing 2010 “Waka Waka”,  team up with Nigerian artiste Burna Boy to produce di song.

For di 67-second video, Shakira enter di  pitch of Maracana for Rio de Janeiro, after she perform free concert for Copacabana Beach last Saturday.

Di song go officially drop on May 14, according to her social media announcement.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds