OBODO NAIJA

Shettima Welcome Govo Mutfwang Enter APC

todayJanuary 28, 2026 5

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Vice Presido Kashima Shettima don officailly welcome Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, enter di All Progressives Congress, praise am say na leader wey sabi welfare and peace.

You sabi say, Konfam bin report dat Mutfwang dump di Pipos Democratic Parti three weeks ago because of di katakata for di party.

For di welcoming ceremony for Jos on Tuesday, Shettima tuk, tuk heaven and earth,  say Mutfwang get ogbonge doings, listing  achievements dat di Plateau govo na peace builder, bring renewable energy, farming and transport.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app