By: Esther Ayoola
South Africa say dem don wash hand comot DR Congo mata say dem dey removeĀ dia soldiers wey dey for UN peacekeeping mission for Democratic Republic of Congo (MONUSCO) afta almost 30 years.
President Cyril Ramaphosa nai dey yarn dis one giveĀ UN Secretary-General Antonio Guterres.
U sabi say, South Africa na one of di top 10 countries wey dey give troops to MONUSCO, with over 700 soldiers.
Oga Ramaphosa say, dem don too use South African army resources, say 27 years, na so UN dey use dem and dat time don reach for dem to comot from DR Congo.