By: Esther Ayoola
Oyo, Ogun and Lagos states don join hand launch joint security operation to stop banditry and wahala for highways and towns for southwest.
Di operation, wey dem call “joint show of force,” dey target high-risk roads like Lagos–Ibadan expressway make commuters, residents and businesses safe, as police begin di exercise from Lagos side go Ojoo, Ibadan on Monday.
CP Fatai Owoseni (RTD), special adviser to Governor Seyi Makinde on security matters, tuk for Oyo state police command headquarters say di exercise na timely and proactive move to tackle security gbege wey dey rise for di area.