obodo oyinbo

Sri Lanka Military To Fight Mosquito

todayJune 24, 2026 6

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Nor be small thing oh, say like Sri Lanka don deploy im military to fight mosquitos, say di mosquito dey misbehave dey spread on deadly  fever wey dem dey call, Dengue fever, say na 1,000 don get dis sickness.

Di office of Presido Anura Kumara, explain, (dat if dem leave di mosquito, di mosquito go show dem sege) say army dem don send now, but e get di way dis mosquito go stubborn reach, dem go send navy and air force to destroy di  mosquito breeding carbarns, since di mosquito nor gree respect demselfs.

Dengue fever na serious sickness wey fit cause high fever, headache, vomiting and body pain, and for worse cases e fit lead to death, naim dis mosquito dey carry.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds